Wednesday 20 September 2017

"Na Comments Sha"

aunty mi, no be say u don age kpa, kpa. but to be say na respect o. e no easy, abi u no, no say, "u be de oprah winfrey of nigeria," na true talk be dat o.

na becos we no dey appreciate as nigerians, if not, "who sai," nobody fit see ur back for dis entertainment buisness.

o, u no, no say u be kind person, wey dey try to dey reach out to anyone, wey wan ur assistance.

hmmmmmmmm... ebe like say my aunty funmi, never sabi wey her level, come reach. abeg, maybe u fit employ me as ur publicist kwo pr. na dem u go sabi say, how ur popularity reach.

"true. i no dey lie. chineke nna dey see me so, as i dey type, so."

aunty funmi, my dear sis, more jeleen to ur elbows, abeg, keep it up. we need u for dis our generation, no be small. na u get courage dey talk wetin some of us no fit talk - ato, nwannem.

may i just leave u, o jare. if not, i go use all de space, tell u all the improvements wey ur show "new dawn" come dey gi de general public.

i salute u once again, my dear sister, may u no gi up, we dey for ur back, dey hail u.

starting from now, "i hail o."




"@ifeomaadiagwuagwu (what is the correct pronounciation of your surname babe?), l dey feel you, my head dey swell."

No comments:

Post a Comment